Soccernet Naija News for Pidgin?

As una know, na Pidgin be awa lingua franca for obodo Naija. Dat na im make us wan ask una, awa readers and fans of Soccernet Naija, weda una go like to dey read some of awa top news for Pidgin?

Make una take dis short survey wey dey under this article to show us weda make we dey write awa news for only Queen’s English abi make we dey write some of di news for Pidgin wey people go fit read. 

We appreciate all awa readers, dat na why we get interest to hear una voice in order to see if we fit make plans for di future.

If una get oda ideas, make una write to us via awa email: [email protected]

[yop_poll id=”1″]